E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.
On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.