11 So Manoah get up kon follow en wife and wen e si di angel, e kon sey, “Na yu bi di man wey tok to my wife dat day?” Di angel ansa, “Yes! Na mi.”
Yu don do wetin Yu tell yor savant, my papa David sey Yu go do; today-today Yu don do as Yu promise.
Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”
Den Manoah sey, “If wetin yu tok so happen, wish kind tins di boy go dey do and wish kind life e go live?”
God angel ansa, “Make sure sey, yor wife do di tins wey I sey make e do.
Den Manoah pray give God, “My God! Abeg, make yor angel kom again kon tell us more tins wey wi go do about di pikin, wen dem don born am.”