Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 13:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Israel pipol sin against God again, so E kon allow Filistia pipol rule dem for forty years.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 13:1
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.


God go pay evry man akordin to wetin e do.


Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets,


Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.


So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem.


So wen e die, dem beri am for Piraton for Efraim, for Amalek pipol hill kountry.


En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol.


So 3,000 men from Judah go di kave for di rock for Etam, go meet Samson kon tell am, “Yu nor know sey na Filistia pipol dey rule us? Wetin yu do to us so?” Samson ansa dem, “I pay dem back for wetin dem do mi.”


Samson lead Israel pipol for twenty years, even doh Filistia pipol still dey rule di land.


Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.


Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju.


Afta Ehud die, Israel pipol sin against God again.


Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years.


“But dem forget di Oga wey bi dia God, so E give dem to Sisera wey bi oga for Hazor sojas, den to Filistia pipol; Moab pipol king and dem kon fight and opress Israel pipol.


So Filistia pipol, make una dey strong kon bihave like men, if not una go serve Hibru pipol di way wey dem don serve una! Make una fight dem like men!”


So Israel pipol win Filistia pipol and dem nor fight Israel pipol again. Thru-out Samuel time, God dey against Filistia pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ