But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.
But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”
King Sihon for Amor wey dey stay Heshbon and dey rule from Aroer (wey dey Arnon Valley korna), plus di town wey dey di valley centre and half of Gilead go rish Jabbok Valley wey dey near Ammon.