28 But Ammon king, nor listin to Jeftah message.
But King Amazaya nor gri listin to am, so King Jehoash for Israel kon attack am. King Jehoash and Amazaya kon meet one-on-one for Bet-Shemesh wey dey Judah.
Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.
I neva do yu any bad tin, but naw, yu dey do mi bad as yu kom attack mi. Make God wey dey judge, judge today between Israel and Ammon pipol!”
Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol.