Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 11:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 11:26
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu wey dey stay Aroer, make yu stand for road kon look well; den ask di pipol wey dey run, wetin dey happen.


Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land.


“So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am!


From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.


But God tell mi, “Make una nor fear, bikos I don give una viktory ova King Og and all en sojas and I go give una all en land. Make una do to am, just as una do to King Sihon for Heshbon town inside Amor.”


Wi judge dem well, both wimen and shidren, just as wi judge King Sihon for Heshbon.


Joshua fight against dis kings for sometaim.


King Sihon for Amor wey dey stay Heshbon and dey rule from Aroer (wey dey Arnon Valley korna), plus di town wey dey di valley centre and half of Gilead go rish Jabbok Valley wey dey near Ammon.


Na-im dey rule Mount Hermon, Salekah, evriwhere for Bashan go rish Geshur, Maakat, half of Ramot pipol borda and King Sihon for Heshbon borda.


and all di town wey Sihon king for Amor wey dey rule Heshbon get, go rish di borda.


Dia aria start from Aroer (wey dey near Arnon Valley) plus di town wey dey di valley centre, evriwhere for Medeba,


Heshbon and all di towns wey dey near am; plus Dibon, Bamot Baal, Bet-Baal-Meon,


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years.


So peace kon dey di land for forty years. Den Otniel wey bi Kenaz pikin kon die.


So Israel pipol win Moab pipol dat day and peace kon dey di land for eight years.


My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.


So Israel pipol win Midian pipol and dem nor kon dey fear dem again. Di land kon get peace for forty years until Gideon die.


Abimelek rule Israel pipol for three years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ