22 Dem take Amor land, from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and from di desert wey dey for east go rish Jordan River for west.
From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.
Aldo wi nor go Ammon pipol land, River Jabbok, di town for di hill or any place wey God sey make wi nor go.
Since di Oga wey bi Israel pipol God don drive Amor pipol komot bikos of en pipol, yu tink sey yu go fit just kom take am from dem?