8 Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years.
So na dis sin go distroy una. Una go bi like high old wall wey don krack and wey go soon fall and na wons e go fall.
Makir wey Manasseh born, en shidren go Gilead, drive Amor pipol wey dey stay der kon take di land.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
Jair die and dem beri am for Kamon.
So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem.
Ammon pipol cross Jordan River go fight Judah, Benjamin and Efraim tribe. And dis tin make Israel pipol weak well-well.
Midian pipol get pawa well-well and Israel pipol kon dey hide for rock and oda place wey dey save for di hills.