Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 10:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 10:7
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na one-one kobo Yu sell yor special pipol and Yu nor gain anytin from inside.


My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


Oga God dey jealous well-well; E dey ponish doz wey dey oppoz am and E dey fight against en enemies!


Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.


Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years.


Israel pipol sin against God again, so E kon allow Filistia pipol rule dem for forty years.


Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.


So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.


Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ