5 Jair die and dem beri am for Kamon.
E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village.
Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years.