11 So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia,
So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside.
So Israel pipol win and kill King Og, en sons and all en pipol, until nobody dey to kill again, den dem kon stay for en land.
Na faith make Israel pipol cross di Red Sea like sey na dry land, but wen Egypt pipol try am, di wota swallow all of dem.
Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.
E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross.
Afta Ehud, di next leader wey Israel get na, Shamgar, Anat pikin and en too save Israel pipol wen e use animal bone take kill 600 Filistia pipol.
“Wen Jakob enter Egypt, una grand-grand papa dem kon kry to God. God send Moses and Aaron and dem lead dem komot from Egypt kon stay for here.