Una wey sey na tree bi una papa and rock na una mama, God go disgrace una. Dis tins go happen, bikos instead of una to follow mi, una kon waka leave mi. But anytime una dey for trobol, una go sey make I kom save una.
Wen Israel pipol kry give God make E help dem, God kon send one man among dem wey save dem. En name na Otniel wey en papa na Kenaz wey bi Kaleb yonga broda.
Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.
Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’
Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.