8 Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.
Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
Afta, dem go fight Kanaan pipol wey dey stay for di hill kountry; Negev and for di hill bottom wey dey for di west side.