Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 1:6
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na di thirtint day for di twelft mont wey bi Adar, na-im dem choose for Jew pipol to do dis tin for King Zazes kingdom.


God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.


Dem tie dia enemies kings with shains and dia priests with iron


Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.


God kon tell Moses, “Make yu stresh yor hand face di sea, so dat di wota go fall kon kover all Egypt sojas, dia shariot and doz wey dey ride dem.”


na dat one bi eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.


Den yu go kill-am, take some of en blood put for di korna for di sons rite ear, di first big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den sprinkol di blood round di altar.


“Naw, mi wey bi God sey, ‘Una don disobey mi; una nor gri free una brodas and sistas. Since na like dat, I go free una so dat war, honga and diziz, go kill una. I go make evry nashon for di world fear for wetin I go do to una.


Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.


Kaleb kon sey, “Di pesin wey go win Kiriat-Sefer, I go gi-am my dota Aksah, as en wife.”


As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol.


So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ