5 As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol.
So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.)
Wen Judah men attack, God make dem win Kanaan and Periz pipol and dem kill 10,000 men wey dey fight war for Bezek town.
King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.
So Israel pipol kon dey stay among Kanaan, Hit, Amor, Perez, Hiv and Jebus pipol
Wen Saul kount all of dem for Bezek, Israel pipol na 300,000 strong men, while Judah men, na 30,000.