Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 1:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 1:29
6 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.


Na Egypt king attack and kapture Geza before. E kill all Geza pipol kon burn di town. But wen en pikin won marry Solomon, e kon gi-am to di girl as marriage gift.


Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.


Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.


Israel pipol kon get pawa well-well and dem force and turn Kanaan pipol to dia slave, but dem nor drive all of dem komot from di land.


Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ