21 Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.
Na Kanaan still born Jebus, Amor, Girgash,
David and Israel pipol go attack Jerusalem. Dat time, dem dey koll Jerusalem, “Jebus”, bikos na Jebus pipol dey stay di land.
All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.
Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today.
Israel pipol nor gri distroy all dia enemies wey dey di land, even doh God sey make dem distroy dem.
Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
Josef shidren-shidren, attack Bethel town and God help dem.
Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der.
Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.