14 Di day wen Otniel dey marry Aksah, e kon tell di girl sey make e ask en papa for land. So as di girl kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont?”
E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.