Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jude 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 But wen Mikael, di big angel dey kworel with devil bikos of Moses body, e nor curse am, but instead, e sey, “Na God go judge yu!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jude 1:9
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”


“Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.


Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia.


“But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.


“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.


So Oga God tell Satan, “Satan! Mi wey bi God rijet all wetin yu tok. Yes! God wey love Jerusalem go kondemn yu. Dis man nor bi like stik wey dem take komot from fire?”


Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.


God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.”


God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.


Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.


even angels wey get pawa pass dem, nor dey tok about dis tins for God present.


Den big fight kon happen for heaven. Mikael and en angels kon fight against di dragon and en angels.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ