Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
“Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok,
Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.