Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jude 1:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jude 1:7
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

wey en pipol wiked and dey sin against God.


Den God tell Abraham, “Di kry against Sodom and Gomorrah too mush and dia sins too many.


Di men kon koll Lot dey sey, “Where di men wey kom meet yu dis evening? Bring dem kom out, so dat wi go sleep with dem!”


E remove all di men and wimen ashawo wey dey woship for di juju altars; di ones wey still remain wen Asa, en papa bi king.


If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.


Na Babilon pipol fine pass for all di kingdom and na dis make dem dey proud. But mi God, go distroy Babilon, just as I take distroy Sodom and Gomorrah!


Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”


Make di pesin bi like town wey God nor sorry for wen E dey distroy tins. Make e hear pipol dey kry with pain for morning and na war kry go full en ear for aftanoon.


Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.


Di ponishment wey I give my pipol worse pass Sodom pipol own, bikos na wons e take happen and nobody dey to help dem.


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


“I distroy some of una town, just as I distroy Sodom and Gomorrah. And una wey remain bi like stik wey dey burn before dem komot am from fire. With all dis one, una still nor gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


I tell una true word, e go betta for Sodom and Gomorrah pipol for judgement day, pass di pipol wey dey for dat town.”


But I tell una, God go get mesi for Sodom pass una for judgement day!”


“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.


but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem.


Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;


Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.


And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.


Den Christ go use fire wey nor dey kwensh take ponish doz wey nor know God and wey nor dey obey wetin wi dey prish about am.


Many pipol go follow dem live dia yeye life. Bikos of dis fake tishas, pipol go tok bad about di trut,


E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life,


Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ