Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.
I nor go ponish una dotas wen dem dey do ashawo or una dota in-law wen dem dey sleep with anoda pesin husband, bikos di men for di temple dey make sakrifice and sleep with ashawo too. So, pipol wey nor get sense, na distroshon go end dia life.
God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.
Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.