Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jude 1:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jude 1:18
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I know sey afta I don go, wiked pipol with bad mind go kom join una and dis pipol nor go sorry for di ship.


But wiked and evil pipol nor go prosper. Dem go deceive odas and dem go deceive diasef too.


Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,


Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem.


Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.


Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ