As all dis tins dey happen, di tent wey Moses build for desert and di altar where dem for dey burnt sakrifice put, still dey where dem for dey woship for Gibeon.
(Naw, e get anoda man wey profesai with God name against di pipol and di town, just as Jeremaya dey profesai. En name na Uriaya wey Shemaya born and e kom from Kiriat-Jearim.
E from der go on-top di hill go rish di spring wota for Neftoah, plus di whole town for Mount Efron, den from Mount Efron to Baalah (wey bi Kiriat-Jearim).
E turn from di west side face sout from di hill wey dey near Bet-Horon for di sout till e rish Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim), di town wey bi Judah tribe own. Dis na di borda for west.
Den, Kiriat-Jearim pipol kom karry di Kovenant Box go Abinadab house wey dey di hill. Dem kon santify Abinadab pikin, Eleazar, so dat e go dey guide di box.