34 Den Joshua read all di word for di law, plus di blessing and di curse, just as dem rite am for di Law Book.
Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.
Dem read di Oga dia God law for dem for like three hour, den dem konfess dia sins kon woship di Oga dia God for di next three hours.
“Den Levi tribe go shaut give Israel pipol sey:
God go ponish una with madness, una eyes go blind and E go konfuse una mind.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.