So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”
Make yu do wetin yu do for Jeriko to Ai, en king and en pipol, but una fit keep dia animals for unasef. Naw, make una dey ready to attack di town from back!”
Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.