7 E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel.
Abiatar pikin, Jonatan and Zadok pikin, Ahimaaz bin dey wait for En-Rogel wotaside wey dey for Jerusalem ending, bikos dem nor fit enter di town. One girl wey bi savant dey go tell dem wetin dey happen all di time and dem go-go tell David.
One day wey Adonijah go sakrifice sheep and fat melu to God on-top di Snake Stone (Zohelet Stone) near En-Rogel wotaside, e invite di oda shidren wey David born and di ofisas wey kom from Judah make dem kom di sakrifice,
Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).