7 E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin.
Jehoshafat kon dey fear, so e go meet God. E kommand evribody for Judah sey make dem fast.
For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.
All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.
Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem.