For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”
For di ninet mont for di fift year wey Jehoiakim bi king for Judah, all di pipol wey dey Jerusalem and di pipol wey kom Jerusalem from Judah, kom fast for God temple.
For judgement day, Nineveh pipol go kondemn di pipol for dis time, bikos wen Jonah prish give dem, dem turn from sin kom meet God. And naw, somebody wey big pass Jonah dey here with una!
For Judgement Day, na so too Nineveh pipol go bear witness against pipol wey dey dis world naw, bikos dem turn from sin kom meet God wen Jonah prish give dem. But naw, pesin wey big pass Jonah dey here.”
Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.