26 So dem ask am again, “Wetin e do? How e take make yu dey si sef?”
Make yu ansa fool akordin to en kweshon, so dat e go know sey e nor wise as e tink, but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am.
Den dem ask am, “Tell us, how yu take rite dis tins, na Jeremaya tell yu?”
Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
Dem ask am, “Wetin happen wey make yu bigin si?”
Naim di Farisee pipol ask am again, “How yu take bigin si?” E ansa dem, “E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si.”
Man ansa dem, “Weda na sina e bi, I nor know! But wetin I know bi sey, before I blind, but naw, I don dey si.”
E kon ansa dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disciples too?”