Naw, make una konfess una sins give di Oga wey bi una grand-grand papa God kon start to do wetin go make belle sweet am. Make una separate unasef from doz strenjas wey dey for awa land and drive all una wife wey nor kom from Israel tribe.”
Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.
Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”
Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!” Den Pilate sey, “Make only una go nail am. But as for mi, I nor si any bad tin wey e do.”
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.