Naim di Farisee pipol ask am again, “How yu take bigin si?” E ansa dem, “E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si.”
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
“Israel pipol, make una hear wetin I dey tok, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di man wey God choose and wey e send to una, wey God use do many mirakles and oda wonderful signs for una front, as all of una know,