Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 9:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 9:16
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”


But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”


But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”


Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok.


Make una bilive sey I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi, but if una nor fit bilive mi, make una bilive bikos of di mirakles wey I dey do.


If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.


Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.


E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.”


Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”


But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.


Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey, “How dis man go give us en flesh make wi chop?”


Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”


Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day?


So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”


But di pipol wey dey di town kon divide; some dey di Jew side and some dey di apostle side.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ