Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 8:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 8:47
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Many pipol go dey klean; dem go klean dem well-well, but wiked pipol go still dey do dia wikedness. No wiked pesin go undastand naw, but na only wise pipol, go fit undastand.


Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.


Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”


I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.


So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”


I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.


Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.


Na bikos I dey tell una true word, naim make una nor gri bilive mi.


Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.


My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ