God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.
Wen God first tok to Israel pipol thru Hosea, E tell am, “Make yu go marry ashawo and just as my pipol don leave mi and nor dey faithful to mi, na so too yor wife nor go dey faithful to yu and e go born shidren wey nor go know dia papa.”
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’
Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.
Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.