39 Dem tell am, “Na Abraham bi awa papa.” Den Jesus ansa dem, “If una bi Abraham pikin, una for dey do di tins wey Abraham do.
make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren!
so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.
Dem tell am, “All of us na Abraham pikin, wi neva bi slave to anybody before. Why yu dey sey, wi go dey free?”
I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.
Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.
Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.”
Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia faith bi like en own, afta dem sekonsaiz am.
Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.
And nor bi all Abraham pikin bi God shidren. Instead, God tell Abraham, “Na thru Isaak yu go get di shidren wey I promise yu.”
And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.
na so too, doz wey bilive, go bi Abraham shidren.