Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 8:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 Na wetin I si wen I dey with my Papa, naim I dey tell una, so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 8:38
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?


Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.


Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.


bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.


But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven, but pipol nor gri listin to am.


Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.


I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.


I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”


Una dey do di tins wey una papa do.” Dem kon tell Jesus, “Awa papa nor born us for outside marriage. Na God ensef bi di papa wey wi get.”


Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ