Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin, dem klose dia eyes make dem nor for fit si and hear with dia ear. Dia mind don block, so dem nor go fit undastand, but if to sey dem fit turn kom meet mi, I for heal dem.’
So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.