Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 8:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 8:34
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

(E nor get any oda pesin wey do dis kind bad tin for God present, like Ahab, just bikos of en wife Jezebel.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen.


Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”


Bikos I si sey na long-trot and bad belle dey worry yu and sin still full yor mind.”


Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins.


Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.


Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.


Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.


Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.


sey one day, God go free dem from deat and wahala and dem go-go join en shidren wey E don save.


bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren.


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ