30 As e dey tok, many pipol kon bilive am.
And many pipol for di place kon bilive Jesus.
Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus, wen dem si wetin happen.
Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast. For der, many pipol kon bilive am, bikos dem si di mirakles wey e do.
So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”
Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”