22 So di Jew oga dem kon dey ask, “Abi e won go kill ensef? As e dey tok sey, ‘Where I dey go, una nor go fit kom der?’ ”
Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.
But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!
Make Yu klose dia lie-lie mout forever; doz pipol wey get bad mout and dey akuiz God pipol.
Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”
Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”
Di pipol ansa Jesus, “Demon don enter yor body! Who won kill yu?”
Den di Jew oga dem kon dey ask each oda, “Where e won go wey wi nor go fit si am, abi e won go tish Jew pipol wey dey stay with Greek pipol?
So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”
Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’
If una dey tink how Jesus sofa for wiked pipol hand and how dem hate am, una mind go strong for faith.
Wi must go meet am for outside di kamp kon share di shame with am.