Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 8:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Den Jesus kon tell dem again, “I dey go and una go look for mi, but una go die inside una sin. Where I dey go, una nor go fit kom der.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 8:21
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.


Dia smooth and betta body, go soon turn to dust.


Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


Small shidren nor go die again and evribody go get long life. Even wen pesin don rish hundred years, dem go sey e still dey yong. If dem die before dat time, e go bi sign sey, I ponish dem.


Make una know sey, una nor go si mi again until una go sey, ‘Make God bless di pesin wey kom with God name!’ ”


“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.


“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”


(E tok like dis, make pipol for know di way e go take die).


Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.


“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.


Una go dey look for mi, but una nor go si mi and una nor go fit kom meet mi for where I dey.”


Wetin e mean wen e tok sey, ‘Una go look for mi, but una nor go si mi and where I dey, una nor go fit kom der?’ ”


Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”


Before-before, na sturbones and sin dey kontrol una life,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ