Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 8:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?” Jesus ansa dem, “Una nor know mi or my Papa, if to sey una know mi, una for know my Papa too.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 8:19
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E judge poor pipol well and evritin go well with am, den God kon sey, ‘Dat na betta ezample to show sey yu know mi.’


I go let dem know sey na mi bi God. Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God, bikos dem go kom back kon serve mi with all dia heart.


For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.


E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


Since dem nor know di Pesin wey send mi kom, dem go do all dis tins to una bikos of my name.


Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa.


Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’


As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.


Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.


But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?


I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.


den una life go betta just as Christ wont. For all di good tins wey una dey do, make una dey bear fruit and learn to know God more-more.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Anybody wey rijet di Pikin, nor get di Papa. But if pesin asept di Pikin, e don asept di Papa too.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ