41 Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.
E first go find en broda Simon kon tell am, “Wi don si di Mezaya”, (wey mean Christ).
Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?” Filip ansa am, “Make yu kom si.”
Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”
“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”
Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”
Wi don bilive and know sey, ‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”
Wisef know di place where dis man from kom and wi know sey anytime wey Christ go kom, nobody go fit know where e go kom from.”
Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”
Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”