40 Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”
Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?” E kon sey, “No, I nor bi Elijah.” Dem ask am again, “Yu bi di profet?” E ansa, “No o-o!”
Di woman kon tell am, “Oga God, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen.
So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”
Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”
Wen e tok finish, di Jew pipol kon leave der dey vex among demsef.