Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?”