Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
“Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.
I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.
Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”