23 Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day?
Una must keep di Sabat Day, bikos e dey holy to una. Anybody wey work for dat days, must die.
One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”
Or una neva read for Moses Law sey, priests dey work for Sabat Day, but nobody dey sey dem kommit sin?
Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”
Den Jesus ansa, “Na one mirakle wey I do so, make una dey sopraiz?
Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.