E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”
Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’