Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 7:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Moses nor give una di law? But una nor gri obey am. Why e bi sey una won kill misef?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 7:19
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.


“But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’


Wen di priest oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan how dem go take kill Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.


Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.


Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


So dem try again to katch am, but e kon waka leave dem.


So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.


Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am.


Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.


“Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite, wey una dey put hope for.


Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am.


Some pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey, “Dis nor bi di man wey dem won kill?


Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.


Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.


Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast.


Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”


Moses give us God kommand, di special place wey E keep for en pipol, Israel.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ